Categories: South Africa

Police arrest man wey dey allegedly trick young ladies with love before e tiff dia phones | #daitngscams | #lovescams


Wia dis foto come from, Gallo Images

Nigerian Police don arrest one man wey dem accuse say im allegedly tiff phone.

But di twist be say, e dey allegedly pretend say im don catch feelings for di women and then, e go tiff dia phone, run.

Tori be say e use dis scam take tiff phone from four women, allegedly.

Police first hear di tori, on Thursday, 11th of November, afta one woman for Kano Municipal LGA report say man wey she say im name na Muhammad don gbab her phone waka.

Di man, bin allegedly tell am say im love am and collect her and her brother phone say im wan buy dem new ones.

As di phones bin dey im hand, im come tell am say e don loss im car key, ask for help to dey find am, but in di process of looking for im key, “Muhammad ” disappear fiam.

Wia dis foto come from, Nigeria Police

For statement wey di police bring come outside dem say di 22 year old suspect, bin allegedly confess afta dem catch am.

E allegedly tok say na im be oga sabi pesin to use sweet words to take win di hearts of im victims before e go disappear with dia phones.

Police say di suspect say so far e don catch four women for im trap and allegedly waka with dia phones,.

Police PPRO for Kano, DSP Abdullahi Haruna Kiyawa say dem gbab di suspect with intelligence patrol and credible informate.

E say investigations still dey go on an and dem go soon carri am go court.

According to di Nigerian Criminal Code, Section 390, e fit spend seven years for prison if dem find am guilty of stealing.

Nigeria get di second most reported cases of romance scams for world only behind di Philipines, according to report from Techshielder.

Di report also tok say na Nigeria be di third kontri wey romance scam don tiff money from pass.



Click Here For The Original Source

. . . . . . .

admin

Share
Published by
admin

Recent Posts

Crypto Fraud on Rise Again, Here’s Why — TradingView News | #datingscams | #lovescams

Recently, SEC Chair Gary Gensler issued fresh warnings about cryptocurrencies amid Bitcoin's surge to a…

1 month ago

My aunt has fallen in love with a scammer | #ukscams | #datingscams | #european

Pay Dirt is Slate’s money advice column. Have a question? Send it to Athena here. (It’s anonymous!) Dear…

1 month ago

Hundreds rescued from love scam centre in the Philippines | #philippines | #philippinesscams | #lovescams

By Virma Simonette & Kelly Ngin Manila and Singapore14 March 2024Image source, Presidential Anti-Organized Crime…

1 month ago

Locals alerted of online dating scams | #daitngscams | #lovescams

Technology has disrupted many aspects of traditional life. When you are sitting at dinner and…

1 month ago

‘Ancestral spirits’ scam: Fake sangomas fleece victims of millions | #daitngscams | #lovescams

Reports of suicides, missing bodies, sexual kompromat and emptied bank accounts as fake sangomas con…

1 month ago

SA woman loses R1.6m to Ugandan lover | #daitngscams | #lovescams

A South African woman has been left with her head in her hands after she…

1 month ago